DEM SAY DEM SAY YARN FOR WE DOMOT FOR FUTO!!!! WHY E BE SAY FUTO HOSTEL GIRLS NO DEY USE EYE SEE WEEKEND?


Gbedu don carry tori enter girl’s hostel as e dey hot for their area every weekend. We don chuk eye find out say majority of hostel girls dey leave hostel wey dem pay for, waka go place wey only dem sabi. This matter wey dey questionable over the years now as the FUTO female hostels dey always dey like wia people run from boko haram invasion during the weekends. Our question come be; why dis shenkes dey comot every weekend? Where dem dey even go dis sabbatical leave?

Our kookoorookoo eye reporter wey vex chuk eye for the matter, come reveal to us say wetin em hear as em go interview these girls clear em doubt well well, as one ogbonge shenkes wey em catch for hostel C yarn am say most of these waka wey these girls dey make na piom! Piom! Piom! Waka. Em open our eye say the population of girls wey we dey see for Umuchima, Eziobodo and Ihiagwa for weekends na Hostel girls wey go sabbatical leave for their boyfriend house. Joyce come yarn her  own view say any Friday you see a hostel girl with a big hand bag know say no be only “mbumchi” she go, but na the whole weekend. She say “if God open your eye see wetin dey dat bag you go fear girls” as most of dem fit squeeze in 3 pants,2 bra, 3 leggings, two tops etc. Em say most of this girls no mind wear their bobo polo wen dey reach their destination if dey see say the cloth dem, carry dey small, as some dey even leave their pant, and bra for the guy house make em fit dey remember say dem go come weekend.  We come waka like kingkong enter hostel D  come ask group of girls wey dey fetch water wetin their own view be towards this ogbonge matter. They come insist say na poor management of the hostel, as well as Nepa wey no dey plus water wey dey hard to see say em dey contribute well well to the sabbatical leave,


We come dey plead with our oga dem at the top wey be importers make dem be careful and  take am easy oo, as e dey worst wen shenkes use em hand export herself come your domot ooo.  We still dey beg our shenkes wey dey involved in this waka say make dem dey sure say na pure waka be dis oo before dey go dey “bellefull” which is automatic 9 months I.T.

Sama Samba

Gbedu reporter

COMMENTS

BLOGGER: 1
Loading...
Name

Academics,1842,Accommodation & Transport,8,Blogger,6,Campus ashiri,19,Dem Say Dem Say,13,Health,12,INTERNATIONAL,20,Love Doctor,20,National,609,Politics,41,Quotes,8,Religion,16,Security,42,soccer prediction,2,Social,88,Sports,18,Technology,92,Throw-back Thursday,11,Upcoming Events,27,
ltr
item
FUTO GBEDU: Whispering into your Ears | Admission lists | Certification Examinations: DEM SAY DEM SAY YARN FOR WE DOMOT FOR FUTO!!!! WHY E BE SAY FUTO HOSTEL GIRLS NO DEY USE EYE SEE WEEKEND?
DEM SAY DEM SAY YARN FOR WE DOMOT FOR FUTO!!!! WHY E BE SAY FUTO HOSTEL GIRLS NO DEY USE EYE SEE WEEKEND?
https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjDqXtjl12Ft1rkK3SFI5qcKTVGiPVN5Lg6bXQvPphtqW_77i-dQX1bG-Cl_-o5YAGjvKAKn6oyAMiAYzLd1RfP8yn8VV4A9xn0hblwdEdcuhF2YX45880ax42oQ12cyYPxZP_d9Z2dLOM/s320/PhotoGrid_1457067104224.jpg
https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjDqXtjl12Ft1rkK3SFI5qcKTVGiPVN5Lg6bXQvPphtqW_77i-dQX1bG-Cl_-o5YAGjvKAKn6oyAMiAYzLd1RfP8yn8VV4A9xn0hblwdEdcuhF2YX45880ax42oQ12cyYPxZP_d9Z2dLOM/s72-c/PhotoGrid_1457067104224.jpg
FUTO GBEDU: Whispering into your Ears | Admission lists | Certification Examinations
https://futogbedu.blogspot.com/2016/03/dem-say-dem-say-yarn-for-we-domot-for_23.html
https://futogbedu.blogspot.com/
http://futogbedu.blogspot.com/
http://futogbedu.blogspot.com/2016/03/dem-say-dem-say-yarn-for-we-domot-for_23.html
true
1266489860930674899
UTF-8
Loaded All Posts Not found any posts VIEW ALL Readmore Reply Cancel reply Delete By Home PAGES POSTS View All RECOMMENDED FOR YOU LABEL ARCHIVE SEARCH ALL POSTS Not found any post match with your request Back Home Sunday Monday Tuesday Wednesday Thursday Friday Saturday Sun Mon Tue Wed Thu Fri Sat January February March April May June July August September October November December Jan Feb Mar Apr May Jun Jul Aug Sep Oct Nov Dec just now 1 minute ago $$1$$ minutes ago 1 hour ago $$1$$ hours ago Yesterday $$1$$ days ago $$1$$ weeks ago more than 5 weeks ago Followers Follow THIS CONTENT IS PREMIUM Please share to unlock Copy All Code Select All Code All codes were copied to your clipboard Can not copy the codes / texts, please press [CTRL]+[C] (or CMD+C with Mac) to copy